Chioma and Davido latest update: See how Nigerians take react to di Musician message to 'Mama Ify' on her birthday
Plenty people
bin dey wonder about di 'couple' relationship for some months now and unconfirmed report say di two don part ways.
Davido and Chioma bin engage in 2019 and dey expected to marry for di year 2020 but di marriage no happun.
Di two have one pikin togeda, Ifeanyi, but tins no be like before for di lovers and dis dey make pipo wonder wetin dey sup about dia relationship.
Di couple neva tok anytin about dia relationship too but dem don stop to dey post each oda photo for social media.
Wetin make 'Mama Ify' dey trend for Twitter?
Chioma on Friday celebrate her 26th birthday and e be like say many pipo bin dey wait to see how Davido go celebrate im 'assurance' but to di surprise of plenti pipo as e post her picture for im Instagram tori wit di message:
''All God's blessings on ur birthday today!
Make una it a great one MAMA IFY'' to which Chioma reply '' Thank you''.


Comments
Post a Comment